4th Street Bar Hive-Bar

Hive-Bar Powered by Hive beta-fdb5b5b

Community post

Afritunes Wk#200 Higher By Tems Cover

▶️ Watch on 3Speak


‎Wats up my people, How una dey? Ehen! It's Afritunes wk#200 and I wan share one of my favourite 9ja songs wey I like to sing almost everyday hehe. This song na one popular song wey be like national anthem for my country people mouth, yes oooh and na one popular artist nai sing am too...
‎Te song name na "Higher" by the one and only Tems

‎E don tey since I last post cover song and e no good 😞. So I don talk say this year, I must take my singing seriously because na something wey dey give me joy all the time.
‎From learning a new song to  how i take deliver am na the process wey I love the most ehn.
‎Honestly, music na something wey just dey very important and beautiful to me because las las, no be everybody go fit still run this singing thing, but me I fit do am wella so I'm highly blessed ( if you no hype yourself who go hype you?) so my fellow musicians for this community, abeg hype yourself oo. 

‎The  song wey I dey do this week na very simple song and I sure say you go like am wella, so sit tight and enjoy...
‎I sure say some of una dey wonder why I dey blow pidgin up and down for this post hehe. My brother /sister,no forget say na Afritunes community be this and pidgin na our tongue so what better way to represent ? .... I sha  hope say I don answer that your question 😊


Lyrics

Tell me why you're crying now kini big deal
‎When you gave me something I don't really feel
‎But you knew that already
‎When I found you on the ground you were dying
‎Now you come into my yard, uninvited
‎Can you see me on the edge, I'm enlightened


source


‎No forget to upvote, and also leave your comment on this post😉

‎Oya thank you for stopping, we go see again for this community next week 😎❤️


‎The cover image na my own


▶️ 3Speak

28 upvotes $0.17

Replies (5)

Review before signing

Posting as . Signing with . Keychain permission: Posting. Hive Keychain will ask you to approve this action next.


  
Technical details

Operation fingerprint: